Vous êtes sur la page 1sur 5

BETTER HELP FOR FAMILY

Imagine house wey fine well well, the owner knack am better paint,
everybody wey pass am dey talk as the building fine no be small. But
if you enter the inside the house you go begin notice sey the roof dey
leak,some pipes don burst, all the plumbing don scatter, the wiring dey
bad, if you on light switch, bulb fit blow, the sockets no dey work
infact e go hard for person to live inside no matter sey the house fine
for outside.
Una know sey nah so some families life dey today? For outside,
husband and wife fit dey laff for people front yet for inside na so so
katakata dey, no peace for the family, and e go hard any visitor to stay
inside house with dem because of the wahala wey dey inside house.
For this hard times wey plenty plenty problems no dey make am easy
for families to dey happy, and wey dey make many marriages dey
scatter ,where families fit get better help to deal with family wahala?
Bible help us understand for Matt 19: 4, sey Jehovah nah him arrange
the institution with the first marriage, meaning sey nah him dey the
best position to tell us how to get better family life,
Jehovah talk sey if we follow im advise , wey dey for bible , we go fit
enjoy family wey belle go dey sweet everybody wey dey the family.
But wetin be some of the things wey dey cause wahala family wey no
dey make dem happy? Bible for 2Tim 3:;1-5 talk about plenty
character wey no dey desirable wey dey affect the peace and
happiness for family, the two of these characters wey dey affect
family nah lack of love for family, and children wey dey
disobedient to their parents, economic pressure because of the
hard times wey we dey live dey, cause disrespect loss of value for
the institution of marriage moral breakdown for society, wey dey
give rise to problems like domestic violence and alcoholism,
gambling and other debased morals dey also affect families.
So how Jehovah take give us help for these issues wey dey cause
katakata for family. We go touch some of these issues and see how
bible take tackle dem.
Abeg make we turn our bibles too Col chapter 3, abeg make we leave
this chapater open because as the talk dey go on e go dey refer to am.
Make we read verse 14. (read). For this scripture, Jehovah tell us
wetin go make family happy and na wetin(Love). Love nah the gum
wey dey hold Jehovah people together and nah so e suppose hold
families together and e dey make dem get one mind. In other words
love go help fmailies apply wetin dem dey read for bible to help dia
family better. Real love no be only wetin we dey feel , we need to put
action dey show sey we love by wetin we dey do and talk.
Today ,many problem for family nah as a result of lack of love among
family members. Some feel sey wen dem talk the words ‘I LOVE
YOU” to their husband or wife or pikin sey dem don try pass, no be
so, love go make each family member do things wey no go only
benefit dem but benefit other people too. For Phil 2: 3,4, there help us
understand sey for husband and wife matter, dem need to dey think
wetin each other need to make dem happy more more.
Abeg make we look verse 19& 21 of the same Col 3.(READ) . The
scripture help us understand sey better husband nah husband wey
carry wetin him family need and wetin go make dem happy for mind
as the most important thing. Verse 19 sey make husbands no vex so
tey dem provoke for their wives. Any husband wey allow himself to
vex reach that point fit no know wen e go vex begin beat im wife, this
one go spoil him relationship with JEHOVAH because Jehovah no go
hear the prayer of that kind man. From that scripture we see sey
husbands suppose instead carry their wives like egg. Make complent
no dey scarce for your mouth for am wen she do something wen sweet
you, no matter how una marriage don tey, even wen she make
comment for meetings encourage am on the comment, as she dey care
for the pikin dem , complement am too. If she vex you abeg no carry
am for mind, una two be one, as you no dey shout for yourself, or beat
yourself wen you do wrong, likewise no do like that to your wife. This
one go make your wife love you more more.
Our wives bible still get talk for una too , make we open col 3;
18(Read). Today, many people dey e good make woman be her own
Oga , sey she no need any man. For English dem call am “Women
Liberation”. Jehovah dey tell us sey nah “Women submission” we
suppose follow, wives need to recognize and submit to their head.
Women wey dey humble, loyal and dey support their husbands dey
make things go well for the family, complement am wen e dress fine,
do part for meetings, do smoothing wey sweet you, Jehovah no want
make wives dey treat their husbands anyhow,dey follow dem argue or
exchange words. If she get her own opinion on any matter for house
she go tell her husband and she go respect any decision him take, even
if no be her own, and if e no work, she go still support am, help am
lok for alternative. No be time to talk “ shebi I tell you as you no dey
hear word, shey you don see wetin don happen”. That one no go show
love, e be like where person chuk another person with knife, so wives
wey dey aoid that kind bad mouth fit make family to dey happy. E go
good make we husband, wife and pikin for family dey tink well well
before we talk we fit ask Jehovah for help to adopt aspect of the fruit
of im holy spirit.
What of Pikin dem, make we read verse 2 of that Col 3(Read) you
see sey pikin wey dey obey im papa and mama no be only dem go dey
happy, Jehovah go dey happy as well. Children take d initiative to dey
make your parents happy, no copy children wey no dey hear God
word dey make your parents mind no come down all the time, pray for
dem, behave well, this one go make family happy well well.
E get some families wey no be everybody dey serve Jehovah or dey do
wetin Jehovah want,for this kind family e go hard make peace dey.
Bible let us know sey Jehovah o bless us if we do everything we fit to
make sure sey we contribute to make d family happy even though sey
e hard. Wetin we need to do nah to make bible as the most important
thing wey dey guide all our behavior. We no go join people wey feel
sey advise from work, neighbors, magazines or radio or television
about family pass the one wey dey bible becos Driver no fit sabi motor
pass person wey manufacture the motor so no human being advise fit
reach im our creator own.
Make we read 1pt 3:;1,2(Read) we dan see sey wife or husband wey
dey serve Jehovah fit make the other person start to serve Jehovah
because of him good character. We dan hear of story of people wey
dan start to dey serve Jehovah today just because their husband or
wife, apply wetin im read for bible about how to make family happy.
Sometimes too, everybody dey serve Jehovah for the family, husband
and wife dey try but one or some of the pikin fit dey cause problem for
house. E fit be sey dem no dey quick do wetin papa and mama dey
talk or dem no wan hear dia own again. Papa and mama need to
follow up that kind pikin, prov 22:15 talk sey foolishness(or to dey
Mumu) dey pikin mind. Wetin go help papa nad mama draw that pikin
close nah to dey patient, listen to dem, follow dem talk from time to
time. Make time to gist better gist with dem, this way you fit get to
know why him dey behave the way im dey behave and den use bible
adjust am. No be on only wen problem done happen you go being
follow dem talk oh! Papa and mama need to remember sey nah to train
pikin to be mature, stable and responsible Christian wey go make the
truth im own nah im sure pass. The pikin go join hand make family
happy and when e grow, im go make im own family dey happy.
Other Problems dey wey dey worry families, Wetin Fit Help Dem
End These Problems Wey No Dey Make Dem Happy, And Which
Blessings Dem Go Get? Abeg Make We Give Bro Bright
Akammadu ear as him go talk this part.

Vous aimerez peut-être aussi